So you wan boycott cow meat? – Frank Ofili
631 viewsAbeg who wan boycott cow meat, make him boycott am. Make una leave me out of your ethnic bigotry. Stop flooding my inbox and WhatsApp with trash.
Na only cow meat you go boycott? What of beans, goat, ram, groundnut, carrot, cucumber etc? You go boycott dem too?
You no see yourself?
The time wey Niger Delta militants and Ijaw Avengers dey bomb everywhere, dey kidnap and kill people nobody told us to boycott fish, banger soup, periwinkle, kpokpo garri, starch or even ogogoro.
Cultists dey massacre people everyday for Rivers State and nobody has told us to boycott roasted plantain and fish.
Even your state governor dey kill pensioners everyday by not paying dem their entitlements, and nobody has urged us to stop praising and worshipping dem.
No be say I dey support killer herdsmen oh, take note. I believe dem, and anybody wey commit murder, should be punished. I have written about this so many times.
I am just saying make una help the country by proffering solution to our security challenges instead of heating up the polity by propagandizing and promoting your ethnic bigotry. It is more annoying when it is some of you so-called men of God who are promoting this ethnic hatred.
